Police fit arrest any pesin or invite anybody come police station. But make we yarn you sey make you no dey panic if you get invitation to the police station. You still get many rights as you dey go police station so and a good police officer go know sey you get rights as you still be innocent. All rights we you get for police station or if dem arrest pesin na weting we explain below for you:

  1. Right to bail – Constitution don provide right to bail for every suspect weda dem go give you condition or not, even if dem go still carry you go court. The constitution talk sey dem must to release accused at least within a day or two days we dem don am.
  2. Right wey give somebody access to a lawyer wey e want – Pesin wey dey police station get right to a lawyer wey e want and dem must not deny am. The reason be sey, the accused get right not to talk or write statement or answer question for police station until e see im lawyer. E dey illegal make police they force accused to talk if e de wait for im lawyer.
  • Right wey no gree make dem abuse or cause injury for pesin. Police dem no get right to dey beat pesin or dey wipe people with koboko, or dey punch pesin especially when the pesin no dey resist arrest.
  1. Dem must tell the suspect the reason why dem dey arrest am. If dem detain pesin and dem not tell am his offence, na illegal arrest.
  2. Another right wey accused pesin get be sey, dem must to carry am go police station after dem don arrest am and dem must all am get access to his lawyer all the time.
  3. Dem must to bring am to court if dem wan trial am on time. Any detention wey dey above 24 hours suppose get court aproval.
  • If dem must to carry pesin go court, the only condition be sey the pesin suppose don commit offence wey our law call and mention as offence. such offence, dem must write am for our sey if pesin do this and this, the name of the offence na this. Our law must to list the offence and punishment for the offence. if dem sey you don commit offence and the offence no dey recognize for allow, abeg call your lawyer sharp sharp.

 

If dem police ask you sey make you write statement, you suppose know how to write one wey no go carry you enter double wahala if your lawyer no dey there.

You need ask yourself sey on top wetin dem invite me to come write statement. Dem invite you as accuse or witness? Becos if pesin go fall into the hands of some wrong officers eventhough some police offers good and professional, dem fit use the statement to blackmail you. You must to take statement wey you wan write as a serious business.

Remember sey you get right not to write am if your lawyer no dey station, some fit shakara you and cause fear for your mind sey dem no go release you.

To write am no hard. Make sure sey wetin you wan put down na something wey you kow untop the mata wey make dem  invite you to police station or if na be sey dem arrest you. E dey very important make you know the reason why or wetin bring you come police station.

If you no dey sure about wetin bring you come, ask the officer, oga, why una take invite me come station.

If dem sey you no commit any offence sey them just want make you write anything wey you know untop any mata, tell them with respect say No.

If dem arrest you becos somebody write petition against you, abeg demand for the copy of the petition wey dem write against you,and read am carefully before you write your statement.

When you start dey write am, make sure sey you explain the reason for why dem say make you write ya statement inside the statement. Make I give you example here. You fit start am like this:

“Dem police stop me as I dey drive my vehicle wey get registration number xxxxx on ________ street in _______ city. After I com show to officer xxxxxxx all my papers, dem come take me to the police station and come yarn me sey dem suspect sey I steal my car”

Then make ya statement and put wetin make dem carry you come police station and offence weY deM sey them suspect sey you commit if you find ya self for situation where lawyer no dey and you must to write the statement urgently.

Now, if third or another pesin read your statement, it suppose dey clear and make sense to am wetin bring about the statement. If you no state wetin happen in your statement to relate well well with your case, dem fit change your case. As you think say dem wan charge you for car theft so, you fit go appear appear for kidnapping matter as one caller share im experience on our weekly #KnowYourRightsNigeria radio programme in Lagos. If a judge dey read your statement for kidnapping case and you know write am make e dey related to to car tefth wey dem police accuse you, the Judge fit think you dey dodge the matter that you no wan answer the question. The judge fit form a negative opinion about you on top your statement because you no explain am clearly and relate am directly or the statement no get end.

Na everybody get right to bail. E fit be:

  1. a) Bail from Police station
  2. b) Bail wen matter don dey court
  3. c) Bail wen mater dey Appeal

 

Bail from Police station:

Constitution don provide right to bail for every suspect weda dem go give you condition or not. Even if dem go still carry pesin go court, dem must to release am at least within a day or two days after dem don arrest am.

Police fit grant bail to pesin on self recognition or dem fit sey make he go bring people we go stand for am as surety. Dem fit ask surety to pay money as a BOND which go make dem report for station later day. This one no be bribe o. Na bond wey the surety go collect back after dem see sey the acusse no run away.

If to sey the gbege wey happen na serious one wey pass police dem to release the suspect, dem police must to charge pesin go court between 24 and 48 hours after dem don put am for detention. The court don talk sey if police arrest pesin and dem still wan carry out more investigation ontop the matter, dem must to relese the person for bail or make dem charge am to court within 24 hours.

Abeg no forget, after dem don charge the pesin go court, police dem no get power to release the pesin again. Na only court go fit grant the pesin bail.

 

Bail wen matter dey court:

Court get power to give pesin bail. Wetin we must know be sey, the level of bad thing wey dem sey pesin do, na im go determine if dem go fit give am bail. At this level, the pesin go need a lawyer.

 

 

MAGISTRATE’S COURT

Magistrate court get power to grant pesin bail[1], but if na strong thing the pesin do wey be sey if dem confirm sey na e do am, it fit land am for 3 years jail, magistartae court fit no wan grant am bcos if na simple trouble now, dem fit give am bail.[2]

 

HIGH COURTS

This ogbonge court get power to grant pesin baill ontop all mata. Make we hear now sey if pesin do strong yamayama thing like killing, armed robbery dem, court no fit grant bail o.[3]

But if the pesin talk sey he need bail, he go need to show court sey the reason why e need bail dey very important reach level wey if dem no give am, na bad thing dem do am[4] . Common example na when pesin dey sick seriously and if dem no allow am go treat himself, the pesin fit die.

 

Before court go grant bail, the court go dey sure of all thing wey we wan explain now:

  1. a) if dem grant am bail, e fit try to spoil investigation?
  2. b) e fit escape.
  3. c) if dem release am, e fit go do bad thing?

 

The ogbonge court wey big pass for Nigeria wey we dey call Supreme Court come talk sey if dem wan give pesinn bail, dem must to look the mater like this[5].

a)make court look the offence wey the pesin commit and punishment wey dem suppose give am weda na strong one or not.

  1. b) the kain trouble wey dem sey the person cause, make court look at evidence wey dem get if na strong one
  2. c) if the pesin no go dey spoil investigation after dem don release am.
  3. d) how the crime wey pesin commit take happen
  4. e) if dem release am, it fit constitute danger for the pesin himself.
  5. f) The pesin fit gocommit same offence if dem release am
  6. g) if the pesin don dey do bad thing tey tey. Na here dem go wan know if the pesin na good man or na so so he dey cause trouble for area.
  7. h) weda the pesin dey sick.

If the pesin dey talk sey make dem relase am ontop sey e dey sick, make e no come go lie bcos court go sey make the pesin show wetin we wan explain now:

  1. the sickness na kind one wey strong wey go fit affect other people wey dey detention with am.
  2. Ogbonge doctor don bring report sey the sickness na true and the sickness fit affect others.
  • Dem no get facility around wey dem go take treat the pesin wey dey sick for detention

[1] See Sections 118 (1) & 341 (1) of the CPA and CPC

[2]See generally Sections.118 CPA;  340& 341 CPC.

[3]See Section. 341 (1) of the 1999 Constitution

[4]See Section 341 (3) CPC. and Abacha Vs The State (2002) FWLR (pt.98) 863 @ 881.

[5]Bamaiyi Vs. The State (2001) 4 SCNJ 103,

If dem arrest person anyhow, put am for detention for wrong way as Constitution no talk am, the person get right to take action. Wetin pesin go get fit be money if the pesin suffer. People wey arrest am fit beg and apologise to am wey members of the public go confirm sey dem don apologise if the matter na small one.

You fit sue anybody wey go arrest you wrongly but you go need a lawyer to helep you o.

  • Introduction

This ogbonge right na one wey the whole world declare sey “Na every human being dey equal and get value and importance. Na every pesin fit think and get conscience wey dem suppose to dey take relate with people around like brothers and sisters”. This right no gree make we treat another pesin anyhow weda na man, woman, abi the pesin no dey practice our religion or e no come from our village or tribe.

You go agree sey some people like to dey wicked other people for area. You go dey hear dem talk for street sey  “meeeeehn! That guy don fuck up! I go chop im face. I go chuck im eyes”. People wey dey talk or do this no like make dem do the same to them or dem relatives oo.

Section 34 for our Constitution come talk sey:

 

We must to respect and value everybody. The Constitution sey –

(a) make we no tourure or do anybody anyhow for wey wey fit bring pain or make dem cry;

(b) make we no use or threat another pesin like slave our use dem do job wey e no fit human being; and

© make we no take force make person do job wey dey hard

 

The 3 example wey we just mention now for constitution no men sey that na only wey dem fit bring pain, cry, or rubbish another pesin value. Court don talk sey as eyes dey open (world dey develop), na so many things wey if we do go make another loose value dey emerge. Wetin fit no disrespect people 20 years ago fit do now as we dey Computer and Mobile App age.

Make we advice our friends wey dey sell market for road wey dey always touch woman body untop sey den sell market, make una take time. You don dey commit wetin law call indecent assault wey be criminal offence. If another pesin take am up, na wahala you cary yourself enter o.

 

For our Constitution for this obodo Nigeria, police no get power to torture pesin, give anybody injury or do anybody anyhow for police station or anywhere. No be only police o, all security people and everyone no suppose torture another.

This right no be small one. The whole world dey concern about torture and dem dem come make one law for all countries make dem no dey torture pesin or give dem injury. Everyone wey go police station, na innocent our law call dem until court see sey na true the pesin do bad thing. Na after that court go convict am before we fit call am bad people. If you torture person and he come later be innocent after investigation or for court, that wan no bad thing.

The constitution and our criminal code no gree make dem  lock pesin anywhere or carry am comot by force from Nigeria. The law go vex for anybody wey hide pesin for a place wey people no go fit get access to am or know where dem hide the pesin.

Again, if person shakara or force you to do wetin law say make you no do, or say make you no do wetin law sey make you do, the person don commit crime o.

Any kind hard work wey go make person look like slave or force am do job wey no fit human being,  our law say make we no force people do am.

Na true our law sey make we no force people do job but some people dey wey fit do work wey hard small and if dem sey make dem do am, dem no go fit complain. The example be this:

  1. If you do bad thing and court sey make you go prison with hard labour, you no fit sey you no do if dem call you come cut grass for example
  2. Any work wey hard small wey dem sey make police or soldier do during work no go fit gualify as force labour oo
  • If you know sey your conscience no gree make you fit work for army, dem fit ask you to to do some work wey fit hard small for another place. You no fit complain.
  • Introduction

This one na right wey dey important pass. Only pesin we dey alive fit talk sey he get rights o. This right dey important sotey if person write Will before he die, na wetin he put for Will sey make dem do with all property he get na so dem must do am o. if anybody go change am, na trouble be dat.

Life get value and our law talk sey make any pesin no kill another.

Section 33(1) for our constitution come talk sey:

 

Na all of us get right to dey live o. No pesin go take life of another but if the pesin go do bad things, dem carry am go court and court come talk sey na tru he do bad thing make dem go kill am, na for only that reason dem fit go kill that pesin o.

 

Wetin the law dey talk here be sey, make we no think am or try sey we wan kill pesin o. Only people wey dem fit kill na people we don do bad thing, dem carry go court and court convict dem sey na true dem do bad thing and court come make dem go kill dem.

Make you hear this o, if court sey make dem go kill persin wey do bad thing, the pesin no come gree and wan go appeal wetin court sey, we must to all am go finsh all appeal wey he dey make o. if dem go kill am when he still dey appeal, govment do bad thing wey be illegal becos dem no suppose tokill  human being wey he dey appel mata for court..

This life, na body give us but God. We must to dey value am. Govment self get work to do as to dey protect our lives and property. This protection  from Govment na for everybody weda you be Naija person or you no be.

People don argue sey belle wey we dey carry na life on its own make we no dey comot am. But ontop weda woman fit commot belle or not, people agree sey wetin dey inside bell get life and dem dey breath too. If dem get hearth beat inside belle, that mean sey life don start be dat. The rights of dem pikin wey dem never born dey protected for Nigeria law,  Africa and international law.

Law dey threat pikin wey dey for belle like sey dem don born am. For example, pikin wey dem never born fit inherit property later o if dem will property to am.

For our law here for obodo Nigeria, to comot belle na gbege oo. Na only condition wey pesin go fit commot belle na if the woman wey carry am dey condition wey if dem no comot belle for am, she fit die.

Wait o! no be you go sey pesin life dey for danger and you wan comot belle for am.  Na ogbonge doctor wey Govment give licence go fit test woman and talk sey dem must to save the life of the woman. This one no be for Sugar-Daddy, boyfriend, mother, friend dem o.

For those wey like to dey take tablet and concoction, come hear this one. The law sey pinkin get power to carry parent go court ontop  injury wey he/she suffer weda na by mistake or no be mistake when the pikin dey belle, when dem dey born am and after dem born am. You now see sey, we suppose dey careful o.