Sexual abuse and exploitation of a child
Sexual abuse and exploitation of a child na form of child sexual abuse wey pesin(s) of any age dey take advantage of power wey dey imbalance to force or entice a child into engaging in sexual activity in return for something wey the child receive and/or pesin wey de perpetrate or facilitate the abuse.
Different way wey dem dey take abuse child include make dem dey child for sexual activities (as dem dey ask, pressurinse or by other means), indecent exposure (of the genitals, female nipples, etc), child grooming and child exploitation, wey include make dem dey use child to produce child pornography.
Safety tips:
*make parents build trust with dia chikdren make dem dey follow dem talk regularly, dey ask dem about their day and make dem dey create a comfortable atmosphere for the children to feel relaxed and report any issue.
*make parents give dia children adequate sexual orientation and mentorship.
*make dem educate children on sexual abuse and other mata wey dey related.
*make parentsdey attentive when their children dey lay complaints for uncomplimentary behaviors wey adult do to dem.
*make parents dey vigilant to dey notice any sudden change in dia child mood or unusual withdraw by a child to her parents, friends, siblings, a particular adult, etc.
Punishment: (State applicable laws and jurisdiction)
Section 222 of the Criminal Code talks sey any pesin who unlawfully and indecently deas with a girl wey dey below 16 years don dey guilty of a misdemeanor and go dey liable to a punishment of 2years imprisonment, with or without caning. If the girl come dey under the age of 13years, he dey guilty of felony and go dey liable to an imprisonment wey reach 3years, with or without caning.

