Child Defilement mean make dem have sex or (enter sexual with a child.

Ogbonge things wey we suppose know to protect children or girl from rape:
We suppose make Children know sey every part of dia body na private and no body should touch am.
Make we teach children how to protect themselves and dey careful
Children suppose know how dem go keep their private spaces
Make we encourage children to speak up if dem dey suspect abuse
If dem abuse children, make dem speak about wetin happen make dem no take da advantage dey abuse dem dey go
Children need make we teach dem to understand the principle wey dem go take protection themselves and how the abuser dey think.

Punishment: (State applicable laws and jurisdiction)
As e dey for the Child’s Right Act for Abuja and plenty states wey don pass the law for dia States, any pesin wey have sexual intercourse with a child don comit a felony and go go prison for life.
As e dey Section 282 (1b) of the Penal Code Act (Wey dem dey use for the North), and Section 218 and Section 221 of the Criminal Code Act (Wey dem dey use for the South), life imprisonment na im be punishment for pesin wey defile a child. Under the Criminal Code Act, this offence and punishment go happen if the child dey under 13 years and 14 years under the Penal Code Act for the North.
If the child dey 13 and under 16 years as we av am for Criminal Code Ac for the Southt, the offender go dey liable to imprisonment for two years where dem fot or no cane am.
For Ogun and Delta State, the law say na life imprisonment for pesin wey defile pesin under 11 years and not 13years.