Raping a woman or girl
Law no gree make anybody go have sex or enter vagina, anus or mouth of a girl/woman if she gree or no gree or by force.
Under our Criminal Code for South and Penal code fir North, if a man go pretend to be the husband of a woman make he fit have sexual intercourse with dat, woman, na rape dem call am. We fit also call Rape kind sexual activity wey law no gree, wey be sey e dey happen say sex happen will the pesin wey dem rape no gree for sex but dem come force am, or treating am or dem go have sex with pesin wey never reach level to give consent for sex under law becos na child she be or she no dey well for sense, or she don high, she dey unconscious or you go lie make you fit have sex with ontop wetin you no fit do. For Nigeria Law, any sex wey pesin have with a girl wey dey below 13 weda she gree or not, na rape becos she dey too small to give consent.
Ogonge things wey we suppose know for this rape mata:
*No dey stay for area wey pipo (people) no dey.
*no dey take alcohol wey dey too much
*No dey take hard drugs or anything wey go make you go high.
*make we educate ourself about things wey we suppose know aboutbSex.
*if you see pesin wey too dey eye you too much for no reason, report.
*no put on anything wey go fit attract make anybody wan dey plan rape
*Defend yaself where e dey necessary.
Punishment: (State applicable laws and jurisdiction)
For Criminal Code for South, anybody wey rape na for life the pesin go prison and dem fit dey cane or make dem no cane am. Under the Penal Code wey dey North, pesin wey rape, na life imprisonment or make dem less am for am with fine or make dem no fine am.
For Ekiti State, dia Violence Against Persons (Prohibition) Acts 2015 talk sey, the small punishment for rape na 12 years imprisonment without fine and the one wey big na life imprisonment. Where the offender who rape no reach 14 years old, the big punishment wey the pesin go get na 14 years imprisonment. Where be sey na gang/group rape, the offenders wey join hands go rape na minimum of 20 years imprisonment. Dem go also make dia names public and put am for a register.

