If dem dey bater (beat-beat) wife or dey torture am
To dey bater (beat-beat) wife na to dey slap, beat, arm twisting, stab, press her neck, choke, kick am and dey do many things wey dey bad to her health and her good life. This kind behaviour to woman for Naija don kill plenty woman or make dem just dey anyhow with problem.
We suppose tell una here say any body wey dey bater woman dey commit crime for Naija. The law no gree no gree and even talk sey make dem punish anybody wey charge man, help am or advise am make he go give woman injury and pipo wey assist am go do this bad thing.
Ogbonge things wey woman suppose know for this mata:
Woman must to dey report if dem batter or torture am
We advise women dem make dem run commot from area where dem wan use weapon take hit dem and make dem report any beat beat or injury
Punishment (As e go happen for each State):
For Ekiti, any pesin wey go cause injury for another, if he use weapon, object don comit ofence and go go prison for 2 years or make e pay fine wey o start from N200k, or make e go prison and pay fine join. (This one dey Section 3(1) of Ekiti State Gender-Based Violence (Prohibition) Law, No 18 0f 2019)
For Lagos, Lagos State Protection against Domestic Violence Law no gree make anybody carry injury go give him wife at all.
For Abia, Akwa-Ibom, Anambra, Bauchi, Benue, Delta, Ebonyi, Edo, Enugu, Jigawa, Kaduna, Kwara, Nasarawa, Ogun, Ondo and Oyo, Violence Against Persons (Prohibition) law wey each state get no gree any kind violence for women at all.
Criminal code for south and penal code for North talks sey na crime make any person go injure or bat women to death for Nigeria.

