When Covid -19 wahala show for Naija, di govment dem introduce lockdown make the disease no finish everybody. Dem close skool, pipo no fit waka about and di step we govment dem take help make covid no reach everybody. On top govment effort, na so katakata bin dey happen for house and plenty wahala as women, girls and pinkin dem com dey sufer violence or gbege for house.
Before COVID-19 wahala show, the kain complain wey our lawyers dem dey receive for ‘Know Your Rights Nigeria” app ontop violence matter wey concern women, girls and pikin no dey reach 10 if we count 100. The time wey lockdown start, the mata don reach 49%. This kind violence cases for house come dey plenty wey be sey na every time news dey carry am wey some woman, girl and pikin don die self on top the mata for Naija.

On top wetin dey happen, we don carry de wowan, girl and pikin matter for our head for our Know Your Rights Nigeria as we won dey ptotect dia right for obodo Naija. This matter for woman, girl and pikin dem na to upgrade wetin we don with technology wey pipo don dey enjoy ontop ‘Know Your Rights Nigeria’ app and ontop internet. The project don dey gidigba and go help our woman, girl and pikin sabi dia rights when kasala dey happen as we don put their write how dem go take understand am for English and Pidgin on top dia Android , iPhone and internet. Ontop this platform evry woman fed dey face violence for home or wey man dey attack go fit chat our lawyers dem ontop this mata wey no body go collect money from them and we go pursue dia mata for dem.

To dey enjoy all the rights wey we don prepare for una, pres da back arrow (<-) wey dey for top make you see all your right, wetin you go do if anybody wan violate ya right, how you go take get lawyer help you fo free, organization wey feed give you dia support service if gbege happen. If you wan report make people no fit see am, go tap “Chat Lawyers” wey dey for the menu of this app.

Know Your Rights Nigeria, na di project of Constitutional Rights Awareness and Liberty Initiative. Dem women, girls and pikin wey we dey protect for English and Pidgin, na Innovation for Change (I4C) Africa support am.