If I comot belle, no be my private affair?

Under our law for obodo Nigeria, abortion na crime o.

Pesin wey be doctor, boyfriend, herbalist, parents, friend who wan do miscarriage for a woman wether e get belle or e no get, and come use something for am or poison or use any force for am or use any other means don enter trouble be dat” [1]

A woman wey wan comot belle come do everything wey we talk above now don enter trouble.[2]

Any pesin who come illegally supply or get anything wey he wan use to comot belle for woman who get belle or no get belle, don comit crime.[3]

[1] Section 228 of the Criminal Code

[2] Section 229 of the Criminal Code

[3] Section 230 of the Criminal Code