If na my rights to worship wetin my mind tell me, I fit join dem secret society?
Our law don sey to join secret cult, na crime for Nigeria.
Section38(4)for our constitution come talk sey:
Nothing wey dey for the provision of the constitution go gree make anyone go form, partake or go join secret society.
Wetin this law dey talk be sey, secret society no dey recognize as a religion for Nigeria and no body go fit sey e join bcos na im right to religion or wetin e belief.

