Dem no write ‘Press freedom’ for our obodo Nigeria constitution o. You sure sey we journalists dey cover to do our job so?

You fit no see make dem type the word ‘Press” uder the Freedom of Expression but the way wey dem take arrange am make am oart if the right[1].  If Freedom of Expressiin dey but the press no come get freedom, then freedom of expression go sey meaningless.

Becos sey Press dey important, our constitution talk am  for section 22 sey:

 

The press, radio, television and other agencies of the mass media dem dey freet to dey advocate  at all time for all fundamental objectiveswey dey under chapterII and make sure sey the Govment sey accountable to the  people.

 

Make we no forget sey this freedom of expression don cover new media such as Blogging/ online radio/ online Tv dem as dem dey pass on opinion, dey receive information like dem radio and TV too.

No be small work dem press people dey do. Na dem dey help us expose corruption, abuse of office and dem official misconduct wey itself dey serve as a deterrent for people wey wan be famous through infamous conduct.

[1] Adewole v. Jakande (1981) 1 NCLR 262; See Section 3 of the Interpretation Act. (1964) (No.1)