Tell me o. church or mosques fit open school dey teach people their religion?

Section 38(3) for our constitution talk sey:

Make dem no stop any religion community or any religion group wey wan dey provide religious instruction for students forv that community or religion group for a place of education wey be sey na the religion community or group dey start and dey maintain that kind place of education.

For here, religious institution get power to give religious instructions in school wey dem establish which also mean sey dem get power to establish school. Court for many years ago don declare sey the action of one state for Nigeria no follow constitution when the state go send circular wey dey suggest sey only government school fit operate for the state.[1]

[1] Adewole v. Jakande (1981) 1 NCLR 262; See also Okogie (Arch Bishop) v. Attorney General Lagos State (1981) 1 NCLR