Dem fit send away Non-Nigerians as law take provide for am. Section 18 for Immigration Act sey dem no go allow people come Nigeria or go send commot from Nigeria foreigner we do all we explain here:

  • Pesin wey no get support or wetin he go fit live if e come Nigeria;
  • Idiot, pesin wey dey insane or dey suffer from mental disorder;
  • pesin wey dem don convict for any country for a crime wey be extradition;
  • pesin wey the Minister for Nigeria belief sey if dem allow am come go be treath to national security;
  • pesin wey dem do deport from Nigeria and the order still dey in force;
  • pesin who-
  1. no get a valid passport; or
  2. be ubder sixteen yearsfor age, e no get valid passport or no get an adult wey go accompanied with valid passport particulars;
  • Any prostitute;
  • Any person wey be or who don be-
  1. Pesin wey dey keep brothel,
  2. Householder wey don permit defilement of a young girl for im premises,
  • pesin wey de allow pesin under thirteen years to be in a brothel,
  1. person wey dey cause or dey encourage girls wey no reach 13 years to dey become prostitutes,
  2. pesin wey dey trade for prostitution, or
  3. pesin wey be prostitute client

 

One treaty dey wey gree do fo me and make I do for (reciprocity) between countries, one country fit surrender its citizen to another country, if dem request for am untop sey e don commit crime for the country wey dey request for am but the pesin don run go im country where dem born am.   This kain process na thru diplomatic channels dem dey take do am.

Before dem go fit extradite the pesin;

  1. The pesin wey dem wan extradite go be somebody wey dem fit extradite
  2. He suppose don commit crime wey fit make dem extradite am

Nigeria fit refuse the request to extradite im citizen if the request no dey inline with her terms of the treaty or the matter wey happen dey related to political or military offences, or e no follow as our constitution talk am or e fit go against national interest of the wey dey make request.

If dem sieze passport, e different from when dey withdrawl pesin passport. If dem withdrawl am, you fit no get am again. If dem seize am, dem fit release am latter. If dem seize am, dem no wan make you movement go beyond Nigeria be dat. People wey dem fit seize their passport na criminal suspect, convict, or somebody wey dey detension  as law take provide.

Article 2(1) for Protocol to the ECOWAS treaty for free movement of persons, residence and establishment[1] give people from ECOWAS countriesthe rights to enter, reside and establish in the territory of dem member states.

The entry without visa no come pass ninety (90) days after which pesin go apply for extensionand na immigration official go fit approve am.

Pesin wey wan go ECOWAS Country from Nigeria suppose get valid passport issued by a member state of ECOWAS wey immigration officials fit endorse[2].

Lastly, ontop sey pesin na from ECOWAS country, dem fit refuse am entry if dem see am as pesin wey dem not fit allow to dem country under dem laws.[3]

[1] Official Journal of ECOWAS, Vol. 1, June 1979

[2] Article 1 & 3 of the Protocol

[3] Article 4 of the Protocol

Though your passport na you rights, dem fit collect am from you as dem take explain am for Passport (Miscellaneous Provisions) Act[1] if this following come happen:

  • If you collect the passport by fraud;
  • If the passport don expire;
  • If pesin dey carry plenty passport at the same time in a way wey law no gree; and
  • If na to collect am from you for public interest.

[1] Section 35(1)

This na your right to travel comot from Nigeria. Before pesin go travel comot from Nigeria, e dey important make e get valid international passport wey Nigeria govment issue. This come mean sey Nigeria citizen get right to own a passport.

Again, pesin must to meet criteria wey dem set befre e fit get passport. The criteria no suppose be one wey go dey difficult for people to meet.

Another important thing be sey, pesin wey wan travel go need get visa of the country wey e dey go. Na embassy of country wey you dey go go give you visa. If you no come get visa, Nigerian authority fit no gree make you commot from Nigeria for airport or place weher you wnan take take off.

The beauty of citizenship na for citizen to dey enter his country at time wey e like. This right na for Naija citizen wey dey abroad  wey wan return home. [1] Pesin wey no be Nigeria dem fit refuse entry for ground of  law.[2]

[1] See section 1(2)(d)&(e) Immigration Act

[2] Sections 7 & 18 Immigration Act

As a Nigerian, no body get right to expel you from Nigeria. As a Nigerian, no body fit deny you dis right. 30 years ago, dem try this kain thing where dem explell (comot) a Nigeria commot from Nigeriabut the court talk sey dem authority no get dat kind power to commot Naija pesin from Nigeria.[1]

 

 

[1] Shugaba V. Minister for Internal Affairs (1981) 1 NCLR 25.

Since every pesin for Naija get freedom to move from one state to another state, the next freedom wey go follow na the right to dey reside for any part of Nigeria weda for short time (Temporarily) or for live (permanently). Every Nigerian dey free to change the place wey im dey reside as e plase am and govment no suppose restrict am weda na Federal, State or local authorities.

Since one of d means to dey enjoy freedom of movement na by movement, the most popular one na by transportation onto Nigeria road. E come dey important here make we know weting be offence wey dey for driving and the kind fine/penalty wey pesin goo pay. We don put am her below courtesy Federal Road Safety Corpse

Offences & Penalties

S/NO TICK INFRINGEMENT (S) CODE POINTS PENALTY CATEGORY
1 LIGHT/SIGN VIOLATION LSV 2 2,000 2
2 ROAD OBSTRUCTION ROB 3 3,000 1
3 ROUTE VIOLATION RTV 5 5,000 1
4 SPEED LIMIT VIOLATION SLV 3 3,000 1
5 VEHICLE LICENCE VIOLATION VLV 3 3,000 2
6 VEHICLE NUMBER PLATE VIOLATION NPV 3 3,000 1
7 DRIVER’S LICENCE VIOLATION DLV 10 10,000 2
8 WRONGFUL OVERTAKING WOV 3 3,000 1
9 ROAD MARKING VIOLATION RMV 5 5,000 1
10 CAUTION SIGN VIOLATION CSV 3 3,000 3
11 DANGEROUS DRIVING DGD 10 50,000 1
12 DRIVING UNDER ALCOHOL OR DRUG INFLUENCE DUI 5 5,000 2
13 OPERATING A VEHICLE WITH FORGED DOCUMENTS OFD 10 20,000 2
14 UNAUTHORIZED REMOVAL OF OR TAMPERING WITH ROAD SIGNS UTS 5 5,000 1
15 DO NOT MOVE VIOLATION DNM 2 2,000 2
16 INADEQUATE CONSTRUCTION WARNING ICW 50,000 1
17 CONSTRUCTION AREA SPEED LIMIT VIOLATION CAV 3 3,000 1
18 FAILURE TO MOVE OVER FMO 3 3,000 1
19 FAILURE TO COVER UNSTABLE MATERIALS FCM 5 5,000 1
20 OVERLOADING OVL 10 10,000 1
21 DRIVING WITH WORN-OUT TYRE OR WITHOUT SPARE TYRE TYY 3 3,000 1
22 DRIVING WITHOUT OR WITH SHATTERED WINDSCREEN VWV 2 2,000 1
23 FAILURE TO FIX RED FLAG ON PROJECTED LOAD FFF 3 3,000 1
24 FAILURE TO REPORT ROAD ACCIDENT FRC 10 20,000 1
25 MEDICAL PERSONNEL OR HOSPITAL REJECTION OF ROAD ACCIDENT VICTIM RAV 50,000 1
26 ASSAULTING MARSHAL ON DUTY AMD 10 10,000 2
27 OBSTRUCTING MARSHAL ON DUTY OMD 2 2,000 2
28 ATTEMPTING TO CORRUPT MARSHAL ACS 10 10,000 2
29 CUSTODY FEE N200 per day after 24 hours
30 DRIVING WITHOUT SPECIFIED FIRE EXTINGUISHER FEV 3 3,000 3
31 DRIVING A COMMERCIAL WITHOUT PASSENGER MANIFEST PMV 10 10,000 2
32 DRIVING WITHOUT SEAT BELT SUV 2 2,000 1
33 USE OF PHONE WHILE DRIVING UPD 4 4,000 1
34 DRIVING A VEHICLE WHILE UNDER 18 YEARS UDR 2,000 1
35 RIDING MOTORCYCLE WITHOUT A CRASH HELMET RMH 2 2,000 1
36 EXCESSIVE SMOKE EMISSION ESE 5 5,000 1
37 MECHANICALLY DEFICIENT VEHICLE MDV 5 5,000 1
NOTE: Custody fee on impounded Motor vehicle and Motorcycle/Tricycle is N200.00 per day payable after initial 24 hours of grace