Na landlord get property. After tenancy end, the premises dey go back to the landlord. People dey own property for many reasons. Some na to get income as some dey use am for investment purposedat’s why dem dey let am out to and collect rent. The rights wey landlord get include:
- Right to dey collect rent: A landlord get right to receive regular and periodic rent form the tenant . e fit collect rent weekly, monthly, quarterly, half-yearly and annually as agreed by the landlord and tenant. However, the manner wey dem go dey collect the rent go dey determined by the period wey dem give to the tenant.
- Right to reasonable periodic inspection of the demised premises: The landlord get right to go dey inspect the property and see how dem dey use im property. But e suppose give notice to the tenant as dem take agree for tenancy agreement.
- Right to lawfully eject a tenant: A landlord get right to eject in a lawful way as dem agree for tenancy agreement or law provide. To eject tenant legally, the notices suppose follow the way law take talk am before dem go fit go court if the mata reach dat level. E dey illegal make landlord dey invite thugs or “Area-boys” to ejecting tenant. Dat kind act fit make you comit crime of disrupting public peace and criminal assault dem.
- Right to review rent: Landlord get the right to review his rent upward ( in the face of economic realities like economic meltdown) and downwards. Such rent reviews go consider rate for the same area make such increase no be to wicked the tenant.
- Right to compensation from compulsory acquisition: The governor of the state through the Land Use Act wan compulsorily acquire the property for public interest “overriding public purposes”, the landlord get right to compensation by the state govment for the improvements wey e don make on the land.[1]
[1] Written by Ayobayo Babade, Tolulope Olusunmade and Olakunbi Yakub of Tope Babade & Co (Real Estate Consultants) as a contribution to #KnowYourRightsNigeria project

