When Covid -19 wahala show for Naija, di govment dem introduce lockdown make the disease no finish everybody. Dem close skool, pipo no fit waka about and di step we govment dem take help make covid no reach everybody. On top govment effort, na so katakata bin dey happen for house and plenty wahala as women, girls and pinkin dem com dey sufer violence or gbege for house.
Before COVID-19 wahala show, the kain complain wey our lawyers dem dey receive for ‘Know Your Rights Nigeria” app ontop violence matter wey concern women, girls and pikin no dey reach 10 if we count 100. The time wey lockdown start, the mata don reach 49%. This kind violence cases for house come dey plenty wey be sey na every time news dey carry am wey some woman, girl and pikin don die self on top the mata for Naija.

On top wetin dey happen, we don carry de wowan, girl and pikin matter for our head for our Know Your Rights Nigeria as we won dey ptotect dia right for obodo Naija. This matter for woman, girl and pikin dem na to upgrade wetin we don with technology wey pipo don dey enjoy ontop ‘Know Your Rights Nigeria’ app and ontop internet. The project don dey gidigba and go help our woman, girl and pikin sabi dia rights when kasala dey happen as we don put their write how dem go take understand am for English and Pidgin on top dia Android , iPhone and internet. Ontop this platform evry woman fed dey face violence for home or wey man dey attack go fit chat our lawyers dem ontop this mata wey no body go collect money from them and we go pursue dia mata for dem.

To dey enjoy all the rights wey we don prepare for una, pres da back arrow (<-) wey dey for top make you see all your right, wetin you go do if anybody wan violate ya right, how you go take get lawyer help you fo free, organization wey feed give you dia support service if gbege happen. If you wan report make people no fit see am, go tap “Chat Lawyers” wey dey for the menu of this app.

Know Your Rights Nigeria, na di project of Constitutional Rights Awareness and Liberty Initiative. Dem women, girls and pikin wey we dey protect for English and Pidgin, na Innovation for Change (I4C) Africa support am.

To dey bater (beat-beat) wife na to dey slap, beat, arm twisting, stab, press her neck, choke, kick am and dey do many things wey dey bad to her health and her good life. This kind behaviour to woman for Naija don kill plenty woman or make dem just dey anyhow with problem.
We suppose tell una here say any body wey dey bater woman dey commit crime for Naija. The law no gree no gree and even talk sey make dem punish anybody wey charge man, help am or advise am make he go give woman injury and pipo wey assist am go do this bad thing.

Ogbonge things wey woman suppose know for this mata:
Woman must to dey report if dem batter or torture am
We advise women dem make dem run commot from area where dem wan use weapon take hit dem and make dem report any beat beat or injury

Punishment (As e go happen for each State):
For Ekiti, any pesin wey go cause injury for another, if he use weapon, object don comit ofence and go go prison for 2 years or make e pay fine wey o start from N200k, or make e go prison and pay fine join. (This one dey Section 3(1) of Ekiti State Gender-Based Violence (Prohibition) Law, No 18 0f 2019)
For Lagos, Lagos State Protection against Domestic Violence Law no gree make anybody carry injury go give him wife at all.
For Abia, Akwa-Ibom, Anambra, Bauchi, Benue, Delta, Ebonyi, Edo, Enugu, Jigawa, Kaduna, Kwara, Nasarawa, Ogun, Ondo and Oyo, Violence Against Persons (Prohibition) law wey each state get no gree any kind violence for women at all.
Criminal code for south and penal code for North talks sey na crime make any person go injure or bat women to death for Nigeria.

To dey force small girl to marry or marry small girl na to dey do so when the girl no want am or gree make she marry. This dey happen when the girl never reach 18 years becos na 18 be de year wey law recognize sey person don dey mature.
Early marriage na to dey give girl for marriage at age wey small when she girl no sabi her rights. For Nigeria, early marriage dey happen like when dem don marry out a girl sharpaly as dem just dey born am. Force marriage na to dey marry a girl wey no want am as e be like say dem wan induce or force am. E don happen say, dem go comot dis girls from skool or dem no go fit get education. Dis dey happen time bcos of culture, social, economic or political reasin.
We fit call Child marriage any marriage wey dey between a child wey never reach and person wey be adult or another person wey never reach 18 years. A child never reach age wey she go fit give consent for marriage. Child Marriage dey abuse child for sex.

Ogbonge things wey we suppose know for this early or force marriage mata:
* we suppose dey encourage our girls make dem fit talk to adult wey dem trust wey go fit help or make dem speak got govment agaency dem wey go fit stop make dem dey abuse dem for sex
*we suppose educate wey wan give im pinkin for early marriage ontop danger wey dey dia.

Punishment:
For state like Ekiti, Ondo, FCT, wey Violence Against Persons (Prohibition) Laws and Child Rights Laws full ground, the punishment wey dey ground for pesin wey do forced marriage na 2 years for prison or make d pesin pay fine wey reach N500,000 or make he go prinson and pay N500k together, or make d pesin go prison for 5 years or pay go prisnon and pay money.
Section 21 for the Child’s Right Act no gree make dem marry child when dem born am or or do child marriage becos pesin wey do am go pay fine wey reach N500,000 or make im go prison for 5 years or make im pay fine and go prison togeda. The pesin wey go enter this wahala na-
(a) pesin wey marry the child; or (b) pesin wey dem give the child wey dem just born for marriage; or (c) pesin wey dey behind the child marriage; or (d) pesin wey give the child out.
For Nigeria, law dey punish child child marriage but this 11 states neva pass the Federal law for dia state wey go punish child marriage, dem be; Kebbi, Kano, Katsina, Sokoto, Jigawa, Zamfara, Bauchi, Yobe, Gombe, Borno and Adamawa.
For Kawara and Kaduna wey dem don make pass Child’s Right Act for dia states, dia law dey diffrent. Section 24(3) for Kaduna State Child Protection Law, d say say a child wey don reach 14 years fot go do marriage for dia Islamic Law. No forget say 18 years na the age of majority.
For Kwara, for section 274 wey dey Kwara State Child Rights Law, 2007, child na pesin we dey under 16 years. If girl wey don reach 16 get married, she no be a child.

Law no gree make anybody go have sex or enter vagina, anus or mouth of a girl/woman if she gree or no gree or by force.
Under our Criminal Code for South and Penal code fir North, if a man go pretend to be the husband of a woman make he fit have sexual intercourse with dat, woman, na rape dem call am. We fit also call Rape kind sexual activity wey law no gree, wey be sey e dey happen say sex happen will the pesin wey dem rape no gree for sex but dem come force am, or treating am or dem go have sex with pesin wey never reach level to give consent for sex under law becos na child she be or she no dey well for sense, or she don high, she dey unconscious or you go lie make you fit have sex with ontop wetin you no fit do. For Nigeria Law, any sex wey pesin have with a girl wey dey below 13 weda she gree or not, na rape becos she dey too small to give consent.

Ogonge things wey we suppose know for this rape mata:
*No dey stay for area wey pipo (people) no dey.
*no dey take alcohol wey dey too much
*No dey take hard drugs or anything wey go make you go high.
*make we educate ourself about things wey we suppose know aboutbSex.
*if you see pesin wey too dey eye you too much for no reason, report.
*no put on anything wey go fit attract make anybody wan dey plan rape
*Defend yaself where e dey necessary.

Punishment: (State applicable laws and jurisdiction)
For Criminal Code for South, anybody wey rape na for life the pesin go prison and dem fit dey cane or make dem no cane am. Under the Penal Code wey dey North, pesin wey rape, na life imprisonment or make dem less am for am with fine or make dem no fine am.
For Ekiti State, dia Violence Against Persons (Prohibition) Acts 2015 talk sey, the small punishment for rape na 12 years imprisonment without fine and the one wey big na life imprisonment. Where the offender who rape no reach 14 years old, the big punishment wey the pesin go get na 14 years imprisonment. Where be sey na gang/group rape, the offenders wey join hands go rape na minimum of 20 years imprisonment. Dem go also make dia names public and put am for a register.

Child Defilement mean make dem have sex or (enter sexual with a child.

Ogbonge things wey we suppose know to protect children or girl from rape:
We suppose make Children know sey every part of dia body na private and no body should touch am.
Make we teach children how to protect themselves and dey careful
Children suppose know how dem go keep their private spaces
Make we encourage children to speak up if dem dey suspect abuse
If dem abuse children, make dem speak about wetin happen make dem no take da advantage dey abuse dem dey go
Children need make we teach dem to understand the principle wey dem go take protection themselves and how the abuser dey think.

Punishment: (State applicable laws and jurisdiction)
As e dey for the Child’s Right Act for Abuja and plenty states wey don pass the law for dia States, any pesin wey have sexual intercourse with a child don comit a felony and go go prison for life.
As e dey Section 282 (1b) of the Penal Code Act (Wey dem dey use for the North), and Section 218 and Section 221 of the Criminal Code Act (Wey dem dey use for the South), life imprisonment na im be punishment for pesin wey defile a child. Under the Criminal Code Act, this offence and punishment go happen if the child dey under 13 years and 14 years under the Penal Code Act for the North.
If the child dey 13 and under 16 years as we av am for Criminal Code Ac for the Southt, the offender go dey liable to imprisonment for two years where dem fot or no cane am.
For Ogun and Delta State, the law say na life imprisonment for pesin wey defile pesin under 11 years and not 13years.

Incest na sexual intercourse between pesin we dey related well-well wey dem no suppose marry each other. Incest na make human being dey have sex as dem dey blood related and sometimes, pesin we dey related by marriage or step family, or pesin wey become family by adoption, clan or lineage.
Na crime for Nigeria as Section 3, subsection 1, sub-sub section b of the Matrimonial Causes Act. Again, Section 33 of the Marriage Act no gree sexual relations and marriage among people wey dey related by blood. It call am one big grama called “Prohibited degree of consanguinity.”This kind relationship or marriage na im the 1st Schedule (Section 3) of the Matrimonial Causes Act, Cap 220, Law of the Federation of Nigeria (LFN) 1990 forbid, it list the kind people wey no suppose dey have sex togeda like father and im daughter, mother and im son, brother and sister, uncle and aunt, niece, and nephew.
If a child dey involved for this one, the offence na Child Defilement and the law wey we don discuss for Child Defilement matter for this app go apply as child no go fit give consent to any kind of sex, wey the pesin dey familial to am or not.

Ogbonge things wey a child suppose know for incest mata:
• Make we dey teach a child on how to identify the abuser in all every way, and let a child know sey anyone fit try to abuse am wey be people we he or she no know yet.
• We must teach dem say stranger na pesin we dem no fit vouch for or trust and e fit include family member.
Wetin evribody suppose know for incest mata:
*No dey dress or remove your dress wia a family member wey be of another sex dey.
*Dry report any move wey fit lead to sex by pesin wey dey related to pesin in the family wey dey older.
* how to defend yaself where it dey necessary.
*how to arrest.

Punishment: (State applicable laws and jurisdiction)
Section 214 (3) for Criminal Code Act, Caption 77, Law of the Federation of Nigeria (LFN) wey dey for South don provide 14 years imprisonment as punishment wey small for pesin wey commit this crime whey the law call am “offence against morality
Section 390 of the Penal Code wey full ground for the North don provide that the offender go be punished with imprisonment wey fit pass seven years and the pesin shall also pay fine.
For Cross river state, any male pesin wey comit the offense of incest dey guilty of a misdemeanor and de pesin fit go prison for 5 years. If the victim come dey below 11 years, he dey guilty of a felony and dey liable to imprisonment for 14 years. If pesin attempt to commit incest, na 2 years imprisonment.
If a child dey involved for this one, the offence na Child Defilement and the law wey we don discuss for Child Defilement matter for this app go apply

Sexual harassment na unwelcome sexual behavior or contact wey dey offensive, humiliating or intimidating. Pesin fit commit am by writing, verbally or physically. It fit happen physically or online. Section 63 of the Ekiti State Gender-Based Violence (Prohibition) Law 2019 don define sexual harassment as unwanted conduct wey be sexual in nature or other conduct based on sex or gender wey dey persistent or serious and demean, humiliate or dey create a hostile or intimidating environment and this fit include physical, verbal or non verbal conduct.
Sexual harassment na unwelcome sexual advances, request for sexual favours, and other visual, verbal or physical conduct of a sexual nature which when dem submit to am or reject am—

(a) affect a pesin employment or educational opportunity or interfere unreasonably with the pesin’s work or educational performance;
(b) implicitly or explicitly suggests say if de pesin submit or rejection of the conduct go fit be a factor in academic or employment decisions; or
(c) dey create an intimidating, hostile or offensive learning or working environment.

Ogbonge guide for children against sexual harassment:
Make children dey speak up if dem dey suspect abuse
Make children dey speak up and talk to adult if pesin wan harass dem
Make we teach children to understand the principles wey dem go take protection demselv and how the abuser dey take think.
General tips:
*Public outcry
*to dey report sexual harassment to higher authority, especially if the offender na pesin wey get connection or dey for high position
*make we teach children how to defend themselves where e dey necessary.

Punishment: (State applicable laws and jurisdiction)
Section 262 of the Criminal Law of Lagos State talk sey any persin wey sexually harasses another commits a felony and go dey liable on conviction to imprisonment for three (3) years.
Dem no mention Sexual Harassment specifically for the Child Rights Act, but it talk about other way wey for sexual abuse wey dey different from defilement.
A pesin wey sexually abuses or sexually exploits a child for any manner wey no dey mention under this Part of the Act don comit an offenceand go dey liable on conviction for imprisonment for fourteen years.
Under the Criminal Code for South wey dey applicable for states like Ogun, Osun, etc, any persin wey dem found guilty go dey liable to imprisonment for a term wey no small pass 2 years or a fine wey no less pass N100,000 or make he pay the money and go imprisonment.

Sexual exploitation na sexual abuse wey pesin of any age dey take advantage of a power wey no balance to force or entice a girl/woman to do sexual activity for am ontop something wey the girl/woman receive from am. These kain abuse fit be rape, prostitution, sexual photography, make dem subject pesin to pornography, or dey witnes sexual acts and assaults which the girl or woman no gree to do or dem out pressure for am to gree.
For a child, any sexual act or offer wey dey harmful to the best interest of the child na sexual exploitation. To dey enslaving a child na to dey use di child for labour wey dey abusive and affect the all-wellbeing of the child.

Ogbonge tips for children against sexual exploitation:
We must to dey encourage girls to speak up
To dey empower parents economically go help.
E dey important to enlighten children about dis unequal behaviours and teach dem to speak up when sem dey push illegal offers to dem
Laws we protect children for dis mata should be enforced
General:
*No dey use hard drugs or abuse alcohol
*Avoiding bad companies.
*No dey put eyes for material things.
*Public outcry.
*Repor to the police.
*Self defence where necessary.

Punishment: (State applicable laws and jurisdiction)
Section 30 of the Child Rights Act no allow make dem dey use child for sale, begging for alms, prostitution (ashawo), hawking ,bondage, slavery, drugs, pornography, or trafficking and list punishment for offender with 10 years imprisonment.
Section 32 of the Child’s right Act tals sey offender wey sexually abuse or sexually exploit in a way not specifically mentioned by the act go dey liable on conviction to imprisonment for fourteen years. This is dey wide ontop sey the issue of abuse against children dey plenty. This one na for any form of sexual abuse wey dem no mentioned for the Act (law).
The Criminal Code Act for the South don provide for Abduction of girls wey dey under sixteen for the purpose of marriage or sex, any offender for dis kind mata go dey guilty of a misdemeanor, and go dey liable to imprisonment for two years. Under the Criminal Law of Lagos State, the punishment na imprisonment for 10 years and the law provide for children wey dey under 18 years.

Sexual abuse & trafficking mean make dem dey use force, fraud or bullying to dey obtain some type of labour or commercial sex acts. This one na a form of sexual abuse wey also be modern day slavery. It also mean to dey recruit, habour, transport, obtain pesin who under threat, force, fraud or force dey induced to perform a commercial sex act.

Safety tips against sexual slavery or trafficking:
*No dey accept jobs wey no get detailed information or specifications.
*Public outcry.
*Report to the police
*Girls and women we suppose enlight dem about these abusive behaviours and teach dem to speak up when dem dey bring illegal offers to dem.

Punishment: (State applicable laws and jurisdiction)
The trafficking in Persons Law Enforcement and Administration Act (TPLEAA) as amended 2015 talk sey na minimum of 2 years imprisonment and a fine of N250,000 for pipo wey do sex and labor trafficking. If the victim na a child, the punishment na a minimum sentence of 7 years imprisonment and a fine wey reach N1,000,000.00
For Edo state, the Edo state anti-trafficking law give a minimum of 5 years imprisonment to pesin wey dey involved for human trafficking.

Forced labour na any work or service wey dem force a woman or to do wey she no wan do, if dem threating to punish am. Na any work a woman or girl dey expose to wey she no wan do but dem threating am with hardship, detention, violence including death, force or other kind hardship.

Safety tips to tackle forced labour:
*Public outcry.
*To dey report such cases to the right authority.

Penalty: (State applicable laws and jurisdiction)
The Trafficking in Persons Law Enforcement and Administration Act (TPLEAA) as amended 2015 no allow forced labour and it punish the act with a minimum of 5 years imprisonment and a fine of N500,000.00