Corporal/hard punishment for children
Corporal/hard punishment na serious punishment wey dem dey give pikin to cause the pikin physical pain wey dey serious. Ecen den do am to pikin, na to cause pain to child bcos he don do bad thing. E fit be spankin, slapin, pushin, hitin with one kain hard object like dat.
Ogbonge Safety tips:
*Make we dey use Light way wey no go cause serious pain to dey correct children.
*Anoda wey to dey correct children wey no go give dem pain e go dey beta.
*Make we no dey use hard thing or iron to dey bet children dem
*Make we no dey hit sensitive part of pinkin wey fit cause dey serious harm.
*Corrections or punishments wey we go give dem suppose dey reasonable.
* Make we dey teach children how dem go protect dia rightsn
Punishment: (State applicable laws and jurisdiction)
Article 222 (1) for the Child’s Right Act 2003 no gree make anybody dey use corporal punishment for child. If di kain injury wey di child carry dey grievous, pesin wey cause am nai im dey go charge unda Section 355 for Criminal Code wey provide for ‘Assault to commit grievous bodily harm’. The offence na felony dem call am and pesin wey dey liable go go prison for 3 years.
E fit no be crime to beat pikin, but some restrictions dey make pesin no do corporal punishment for pikin. Section 211 talk on on way wey law no permit to deal with pikin. The aw talk sey
(1) make dem no do the following to a pikin‐
(a) lock am or imprison am; or giva am corporal punishment
The Child’s Right Act too don provide for Child’s Dignity and make anybody no dehumanize dem.
Pinkin fit get right to sue if dem do am or give am bad or wicked treatment

