Female Genital Mutilation & other harmful traditional practices
Female genital mutilation (FGM) na to dey remove totally or small the outer part of female genitalia or cause oda injury to the female genital organ on top mata wey no get medical reasons.
The Constitution for the Federal Republic of Nigeria (1999) fit no mention specifically about violence against women and girls, harmful traditional practices or FGM; but Section 34(1) talks sey na every pesin dey entitled to respect for the dignity of dia pesin and, make anybody no go torture, or give inhuman or degrading treatment to anoda pesin.
The Violence Against Persons (Prohibition) Act, 2015 (VAPP Act) n aim be de law wey criminalise FGM as it talk for Section 6(1) of the law sey circumcision or genital mutilation of the girl child or woman dey prohibited.’
Section 6(2) don criminalise and go punish pesin who go perform, or dey engage anoda pesin to perform, female circumcision or genital mutilation.
Section 6(3) don criminalise and punish pesin wey attempt or perform, or go engage anoda pesin to perform, the practice.
Finally, Section 6(4) don criminalise and punish those wey incite, aid, abet or counsel anoda pipo make dem perform or attempt to perform FGM.
Ogbonge Safety tips:
*Orientation for pregnant women.
*Sensitization and awareness for di general public.
*Make women dey give birth for licensed hospital or Medical centers
Punishment: (State applicable laws and jurisdiction)
The Violence Against Persons (Prohibition) Acts which some states don pass the law like Ondo, Oyo, Edo, don provided this criminal penalties/punishment for pesin wey go commit the offence wey we list down here:
if pesin perform Female Genital Mutilation or come engage anoda pesin to perform FGM go go prison wey no pass 4 years or a fine wey no pass 200,000.00 Naira (US$554.808), or make e go prison and pay fine join.
If pesin come attempt to perform FGM or dey engage anoda to perform FGM, dat one carry punishment of imprisonment wey no pass 2 years or to pay fine wey no pass 100,000.00 Naira (US$277.309), or make e go prison and pay fine join.
Anybody wey come incite, aid, abet, or advise anoda pesin make e perform FGM or engage anoda to perform FGM dey liable on conviction to imprisonment wey no pass two years or to a fine wey no pass 100,000.00 Naira (US$277.3010), or make e go prison and pay fine join.
Some States don set dia own punishment for pipo wey go do FGM. For example:
For Cross Rivers state – The Girl-Child Marriages and Female Circumcision (Prohibition) Law (2000), Section 4 talk sey anybody wey go perform FGM, or the female go offer herself for FGM, or pesin com coerce, entice or induce anoda to do FGM or allow any female wey be daughter or ward to go do FGM go dey liable on conviction to a fine wey no less pass 10,000 Naira (US$27.7011) or go prison wey no pass two years for a first offender (and go prison wey no pass three years with no option of fine for pesin wey do dey commit the offence more dan once).
For Ebonyi state, na five-year prison sentence for anybody wey carries out FGM.
For Edo state – The Prohibition of Female Genital Mutilation Law (1999) talk sey the punishment for pesin wey go perform FGM na imprisonment wey no dey below three years or a fine wey no dey below 3,000 Naira(US$8.3012) or make e go prison and pay fine join.
For Rivers state – The Child Rights Act (2009), Section 25 talk sey pesin wey directly or indirectly cause a female child to be subjected to FGM go dey liable on conviction to a fine not wey no pass 50,000 Naira (US$138.6014) or imprisonment for one year, or make e go prison and pay fine joins.
Anoda:
Punishments don dey for medical malpractice unda the Medical Act (2004), Section 16(2) talk sey dem go remove medical practitioner wey be Doctor, Nurse dem from register and dem no go allo dem practice for a period wey no pass six months if dem go do FGM.
A pesin wey comit an offence by the removal of tissue as dem talk am unda the National Health Act 2014 na im dem go punish under Section 48(3)(a) with a fine of 1,000,000 Naira (US$2,77315) or imprisonment wey no dey below 2 years, or make e go prison and pay fine join.

