Harmful Widowhood practices
Harmful widowhood practices na various rites and practices which dem dey make woman wey lose im husband go tru either before, during or after the funeral rites of her husband wey don die. These practices dey difrent from one culture to anoda. Some of these practices include make dem dey mourn, shave women hair, make am compulsory to stay inside for long period of time, to dey wear black dresses, drinking of water wey dem use to wash the body of husband wey don die, to dey waka with bare foot etc.
Safety tips:
*To dey sensitize the general public.
*to abolish some unhealthy widowhood practices wey dey dangerous to the health and life of widow dem.
*Make we dey enforce laws wey dem make to stop these acts wey dey hamful to women dem.
*Widows wey dey this kain situations should speak up or contact either personally or by proxy the ministry of Women Affairs wey dey close to dem
*Public outcry.
*Prosecution of the pipo wey dey do these harmful act to widow.
Punishment: (State applicable laws and jurisdiction)
Unda the Violence Against Persons (Prohibition) Act 2015 wey dey operational for the Federal Capital Territory, the punishment na 2years imprisonment or and fine of N500,000, for any pesin wey subjects a widow to any harmful traditional practice. Punishments for attempting such offence or pesin dey assist and aiding an offender na imprisonment for 1year and or fine of N200,000.

