I get right to practice religion wey I like?

Becos sey religious believe na sensitive mata wey dey arguable, the courts no dey inquire weda the religion wey everybody dey claim na true or na lie.[1]

Justice Ayoola when he still dey Supreme Court of Nigeria come explain sey this right dem no suppose prevent anybody to dey enjoy am except sey reason wey law recognize. He sey people get right to choose their belief dem must not force anybody against wetin e no belief for his religion. But this right get limitation if if pesin dey use am violate rights of others or when e fit bring danger to the society.[2]

[1] Church of the New Faith v. Commissioner of Pay Roll Tax (1983) 57 ALJR 785

[2] Medical and Dental Practitioners Disciplinary Tribunal v. Okonkwo (2001) 10 WRN 1 SC at 41