Wetin concern others with weting I dey follow people talk for phone or letter?

Naija people dem get right make anybody pokenose ontop their message, telephone discussion including telegraphic communications. This right cover wetin dem post or dey send for internet, social media. The content wey dem cover inside no other pesin suppose see am except sey the sender put am make others fit see am.

Na crime to they stop, search, rob, hid or destroy postal matter or telegram[1]. Infact all style wey govment dem wan use to regulate social media don make people react sharp sharp against am becos the right of people to dey communicate dem fit dey tampwer.

We suppose tell una sey Section 45 of the Constitution no make this this right supreme which come they make police, DSS dem dey access our phone conversation ontop sey make our national security no come enter gbege.

[1] Section 161 and 162 of Criminal Code