Stalking or intimidating woman or girl
Stalking na unwanted and/or repeated close-watch wey a pesin or group dey carry out ontop anoda pesin. As technology don come, stalking for internet don dey comon. This Cyber stalking na criminal offence as section 24 of the Cybercrime (Prohibition, Prevention, etc) talk am. The law ban make pesin dey send obscene messages or messages wey dem wan take bully or intimidate anoda.
Ogbonge tips wet we fit use tackle stalking:
*education wey full ground for cyber safety
*make we teach our Children how dem go take deal with online
*make children dem dey follow adult talk any time dem see sey pesin dey act strange behaviour.
Punishment: (State applicable laws and jurisdiction)
Section 24(1) of the Cybercrime (Prohibition, Prevention) Act come talk sey:
Any pesin wey knowingly or intentionally come send a message or oda mata tru computer systems or network wey –
(a) dey very offensive, pornographic or wey dey filthy, obscene or wey dey threatening character or dey cause any dat kind message or mata wey dem send; or
(b) the pesin know sey na false, but to cause annoyance, inconvenience, danger, obstruction, insult, injury, criminal intimidation, enmity, hatred, ill will or needless anxiety to anoda pesin or come send such a message: don comit an offence under this Act and go dey liable on conviction to a fine wey no pass N7,000,000.00 or imprisonment wey no pass 3 years or make the pesin collect the fine and imprisonment togeda.
Section 24 (2) talk sey: Any pesin wey knowingly or intentionally come send a message or oda mata tru computer systems or network –
(a) to bully, threaten or harass anoda pesin, where such communication com place anoda pesin for fear of death, violence or bodily harm or to anoda pesin;
b) wey contain any threat to kidnap pesin or any threat to harm anoda pesin, demand or request for a ransom for the release pesin wey dem kidnap, to extort money or any thing wey get value from any pesin, firm, association or corporation; or
(c) wey contain any threat to harm the property or reputation of the pesin or anoda pesin or the reputation wey pesin wey don die get or any threat to accuse the pesin wey dem dey target or anoda pesin for crime, to extort money or any ting wey get value from any pesin, firm, association, or corporation don comit offence under this Act and the pesin go dey liable on conviction-
(i) for case wey fall unda paragraphs (a) and (b) of this subsection na imprisonment for a term of 10 years and/or a minimum fine of N25,000,000.00; and
(ii) for case wey fall unda paragraph (c) for this subsection, na imprisonment for a term of 5 years and/or a minimum fine of N15,000,000.00.
As Section 24 (3) talk am, court fit also make an order, to dey protect the victim or victims of the offence, or any pesin mentioned in the order, make in no dey do anything wey fit intimidate the victim.

